Wia dis foto come from, Presidency/Getty Images
Di All Progressives Congress (APC) Presidential Campaign Council dey defend di campaign promise wey Nigeria President Bola Tinubu bin make bifor e enta office for 2023.
One of di president 2023 campaign promise na to end estimated billing and to also make sure say electricity supply for Nigeria dey steady.
But di APC campaign council say di opposition don take di tok out of context.
Dem make dis position afta opposition party presidential candidate for di African Democratic Congress (ADC) Atiku Abubakar criticise am say e fail to fulfil im campaign promise to provide Nigerians wit steady electricity.
Di ADC Presidential Campaign Council drag president Bola Tinubu sake of say promise wey e bin make to end estimated billing for electricity.
But wetin President Bola Tinubu really promise Nigerians for 2023, electricity follow?
End of content
President Bola Tinubu 2023 campaign promises on electricity
For one document wey e title 'Renewed Hope 2023, Action plan for a better Nigeria' President Bola Tinubu write di tins e go do for Nigeria inside di document wey get 80 pages.
E tok about National security, education, agriculture, power, oil and gas, transportation, health, digital economy, sports and oda tins.
End of Di one wey oda users dey read well well
Inside di document, e tok about Power-electricity inside page 30-32 wit di title;
'Power di way to a brighter Nigeria' wia e say dem no go fit solve Nigeria power problems overnight.
"We go immediately take di necessary steps to make sure say more of di power we already dey generate fit dey transmitted and distributed to Nigerian homes and businesses."
For im long term plan for electricity, oga Tinubu say im go seek to implement further reforms to put nation on track to sufficient on-grid generation, transmission and distribution to power di bright Nigeria of our dreams.
E bin also promise Off-grid and renewable power generation options and solutions
wey pipo for by private sector wey dey willing go do.
"Our administration go will work wit di private sector and interested State
Governments to provide access to low cost finance for power projects."
Concerning estimated billing, oga Tinubu bin promise to remove am kpatakpata.
"We go end dis unpopular and harmful practice and ensure all electricity
bills dey meter-based.
Im bin explain say dem do achieve am by streamlining and make
existing schemes like di National Mass Metering Programme and di
Meter Asset Provider Scheme to work shrap-sharp.
'We go seek to ensure say all electricity connections dey properly metered wit di shortest time frame. We no go permit new connections to light from di Grid unless dem don install di meter finish."
For solar energy plan im bin tok say e go focus on all major parts of di power value chain to ensure say pipo take advantage of all di solar power get to offer in terms of
generating, transmitting and distributing residential solar power solutions.
E also tok about support for domestic manufacturing of Electricity Meters wia e promise say im govment go reduce import levies on manufacturing
"We go streamline and relax regulations to enable private sector, local and state
govment actors to electrify rural Nigeria in safe and secure manner wit
reasonable tariffs.
Oga Tinubu also tok about di Nigeria First Power Policy wia dem go direct gas resources as di number one priority to Nigerian power generation.
"We go work with di National Assembly to review di Electric Power Sector Reform
Act 2005 and reform di regulatory and governance structure of our nation
power sector."
Na all dis promises wey President Bola Tinubu bin make ahead of di 2023 election na im former Vice President Atiku Abubakar hold dey drag am.
Atiku for statement say "Tinubu electricity excuse no go fit light single home"
For inside di statement wey Phrank Shaibu, Director of Strategic Communication of di ADC Presidential Campaign Council issue, Atiku say make di APC stop to dey celebrate paperwork while pipo dey inside darkness for dia homes and businesses.
"After three and half years, families still struggle to keep dia homes lit. Traders and small business owners spend scarce resources on alternative power, yet struggle to keep dia businesses alive. Nigerians are billed for electricity wey dem no go fit rely on. President Tinubu bin promise steady power and to end estimated billing. E neva keep dat promise yet.
Atiku also tok about di plenty bands wey Nigerians dey use depending on di nukber of hours dem dey get light in one day.
"Across Nigeria, consumers dey placed in Bands A, B, C, D and E and dem dey charge different rates. In many areas, Band A customers pay about ₦209.50 per unit bifore VAT. Rates for di oda bands dey diffferent by state and electricity provider. Yet across evri band, di same hardship dey: di power dey fail, but di bill dey come. No family suppose weigh di cost of electricity against di cost of food. No business ssuppose pay more wen dem dey receive less.
Oda tins Atikun tok about na
"Di govment plan to end electricity subsidies from 2027, even as dem insist say immediate tariff increase no go dey."
Im add say wen President Tinubu bin campaign for 2022, in bin make unmistakable commitment. im tok say : 'If I no give you constant electricity for four years, wen I come back for second term, no vote for me."
According to Atiku Nigerians don pass through di four years. Dem no need im campaign council to interpret im words for dem. Dem need am to answer for dem."
'Ova 1.5 million customers get meter under di Presidential Metering Initiative - APC
For APC response, di party tok say make pipo consider wetin oga Tinubu bin tok dat time in full context.
Dem say na for one meeting wit members of di Organised Private Sector (OPS) for Lagos ahead of di 2023 general elections na im Bola Ahmed Tinubu bin dey tok how im go tackle some of di institutional problems wey Nigeria power sector dey face for more dan five decades.
According to Dele Alake wey be di Spokesperson for di APC Campaign Council, im say Tinu exact words dat time na "Whichever way, by all means necessary, you go get electricity, and you no go pay for estimated bills anymore. A promise made go be a promise kept. If I no keep di promise and I come for second term, no vote for me, unless I give you adequate reasons why I no fit deliver."
Oga Dele say dem still dey fix di power sector crisis wey neva finish. Im say di President dey work consistently to deliver on im promise to Nigerians, and im commitment to face di challenges head-on neva reduce.
Some of di tins in highlight wey President Tinubu don do for di power sector include:
Signing di Electricity Act, 2023 on June 9 wey liberalised and deregulate di power sector, wey move am from di Exclusive List so dat states and subnationals participate for power generation, distribution, and transmission wey states like
Lagos, Enugu, Abia, Ekiti, Oyo, Kaduna and Niger dey take advantage of.
President Tinubu bin take ova N6 trillion legacy debt wey bin accumulate from 2015 to 2025. Im start di Presidential Metering Initiative to close di ova 7 million Metering gap.
Dele Alake add say in di last three years, over 1.5 million customers get meter under di Presidential Metering Initiative.
Di Rural Electrification Agency don also connect universities, hospitals, and rural communities to solar power.
Di administration create N4 trillion bond programme to settle verified legacy debts to 21 power generating companies (Gencos) and gas companies (Gascos).
E say dem still dey fix di electricity market and power sector and President Tinubu neva comot one inch from im commitment.
Wetin be di reality on ground for Nigeria
Wetin Nigerians dey face be say, for some states and areas light dey while some oda parts no dey too get light.
Di national grid still dey collapse up and down, for 2026 alone e collapse pass six times and Nigerians still dey ask why National Grid dey collapse evritime
Nigeria for some areas dey use meter while some pipo still dey use estimated billing.
Discover more
Ginger Me
End of Ginger Me




